1
Acts 2:38
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Pita ansa dem, “Make una turn from sin kom meet God one-by-one and make dem baptize una with Jesus Christ name, so dat God go forgive una, den una go fit receive di Holy Spirit.
Cymharu
Archwiliwch Acts 2:38
2
Acts 2:42
Dem kon dey use all dia time dey learn wetin di apostles dey tish. Dem dey waka, help, chop and pray togeda.
Archwiliwch Acts 2:42
3
Acts 2:4
Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
Archwiliwch Acts 2:4
4
Acts 2:2-4
At wons, one kind nois wey bi like heavy breeze kom from heaven kon full di whole house where dem sidan. Dem kon si small-small fire wey bi like kandol lite dey fall kom from heaven on-top dia head, one-by-one. Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.
Archwiliwch Acts 2:2-4
5
Acts 2:46-47
Dem dey stay togeda evriday like one big family. Dem dey gada go di temple togeda and dem dey go from house to house, dey chop togeda with happiness. Dem kon dey praiz God and dey fellowship with one anoda. So God kon dey add more pipol join dem evriday.
Archwiliwch Acts 2:46-47
6
Acts 2:17
“ ‘Wen di last day don rish, God sey, “I go pour my Spirit inside evribody and all una shidren, both boys and girls go dey profesai, una yong men go dey si vishon and una old men go dey dream plenty dreams.
Archwiliwch Acts 2:17
7
Acts 2:44-45
All di pipol wey bilive, dey share dia propaty with one anoda and stay togeda. Dem dey sell wetin dem get kon use di money dey help each oda.
Archwiliwch Acts 2:44-45
8
Acts 2:21
For dat time, evribody wey koll God name, God go save am.” ’
Archwiliwch Acts 2:21
9
Acts 2:20
Di sun go black and di moon go red like blood, before di big day wen God tok about, go rish.
Archwiliwch Acts 2:20
Gartref
Beibl
Cynlluniau
Fideos