Rut 1
1
Elimelek Go Moab
1For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body. 2(Di man name na Elimelek and en wife name na Naomi. E get two shidren wey bi Mahlon and Kilion. Dem kom from Efrat family wey dey Betlehem for Judah.)
3Afta sometaim, Naomi husband, Elimelek kon die leave di woman and en two pikin. 4So di shidren marry wimen from Moab and dia name na Orpah and Rut. Dem kon stay for Moab for anoda ten years. 5Den Naomi two sons, Mahlon and Kilion kon die too. So Naomi nor get husband or shidren again.
6So Naomi kon decide sey e go-go back to Betlehem (and en shidren wifes follow am), bikos as e dey for Moab, e hear sey God don bless en pipol and honga nor dey dia land again.
Rut Follow Naomi Go
7So, wen en and en two pikin wife komot for where dem dey stay kon dey go back to Judah, 8Naomi kon tell di wimen, “Make una listin to mi! Make una go back to una mama house! Make God show una en favor just as una don show am to mi and my shidren wey don die! 9Make God guide una for una new husband house!”
Den e kiss dem kon sey bye-bye and dem kon dey kry. 10But di wimen tell am, “No! Wi go follow yu go meet yor pipol.”
11So Naomi ansa dem, “My dotas! Make una dey go house! No nid to follow mi go back to Judah! I nor go fit born pikin wey go bi una husband again! 12My dotas, make una dey go house! I don old well-well to marry again. Even if I feel sey hope still dey to marry dis nite kon get belle born pikin, 13true-true una nor go won wait until dem big rish to marry una! Una nor go fit stay thru-out dat time without husband. Yes! Una nor go fit wait. So my dotas, make una nor follow mi go, bikos my wahala and sofa too many for una to karry and na God dey ponish mi!”
14Dem kon kry well-well again. Den Orpah kiss Naomi kon go back, but Rut nor gri go.
15So Naomi tell am, “Si, yor husband broda wife dey go back go meet en pipol and en god. So make yu follow yor husband broda wife go back!”
16But Rut ansa, “Nor force mi sey make I leave yu! Anywhere wey yu go, na der I go-go. Anywhere wey yu won stay, na der I go stay. Yor pipol go bi my pipol and yor God go bi my God. 17Where yu for die, I go die for der too and na der dem go beri mi put. Make God ponish mi well-well if I nor do wetin I promise! Na only deat go fit separate mi from yu!” 18Wen Naomi si sey Rut sirious to follow am go, e kon stop to tell am make e go back.
Naomi And Rut For Betlehem
19So dem two kon travel until dem rish Betlehem. As dem rish der, di whole village happy sey dem kom. Di wimen for di village kon sey, “Na Naomi bi dis?”
20Naomi ansa, “Make una nor koll mi, ‘Naomi’, but make una koll mi ‘Mara’, bikos God wey get pawa don ponish mi well-well. 21I komot here with my husband and shidren, but God don make mi kom back with empty hand. Wetin make una dey koll mi, ‘Naomi,’ wen una si sey God tok against mi and di One wey get pawa don make mi dey sofa?”
22So na like dis Naomi take kom back from Moab with Rut, en pikin, Mahlon wife. Dem rish Betlehem wen grain harvest just dey start.
Currently Selected:
Rut 1: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee