Luke 7:7-9
Luke 7:7-9 PCM
Na dis make mi nor waka kom meet yu, instead, make yu just give orda and my savant go well. Bikos mi too get pipol wey big pass mi and I get di ones wey I big pass. If I tell one, ‘Go!’ E go-go and anoda one, ‘Kom!’ E go kom and if I tell my savant, ‘Do dis tin!’ E go do am.” Wen Jesus hear dis, e sopraiz and belle sweet am, naim e look di pipol wey dey follow am kon tell dem, “I tell una true word, I neva si dis kind faith before, even for Israel.”