YouVersion Logo
Search Icon

Luke 4:9-12

Luke 4:9-12 PCM

Den devil take Jesus go Jerusalem kon make am stand on-top di place where high pass for di temple kon tell am, “If yu really bi God Pikin, make yu jump go down, bikos God word sey, “ ‘God go tell en angels make dem guide yu’ and, ‘Dem go karry yu for dia hand, so dat yu nor go use yor leg nak stone.’ ” Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor test God wey bi yor Oga God.’ ”