YouVersion Logo
Search Icon

Luke 23

23
Dem Take Jesus Go Meet Pilate
1Den di Farisee pipol and di oda pipol take Jesus go meet Pilate, 2dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”
3Pilate kon ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?”
Jesus ansa, “Na as yu tok.”
4Den Pilate tell di priest oga dem and di pipol, “I nor si anytin wey go make mi kondemn dis man.”
5But dem still sey, “E dey kause wahala with wetin e dey tish pipol for Judea. E start am for Galilee and naw e don kom here!”
Dem Take Jesus Go Meet Herod
6Wen Pilate hear dis one, e kon ask weda Jesus na Galilee pesin. 7Wen e hear sey Jesus kom from Jerusalem, where Herod dey rule for dat time, e kon sey make dem take Jesus go meet am.
8Wen Herod si Jesus, e happy well-well, bikos e don tey wen e won si am since e hear about am. E dey hope sey Jesus go do mirakle for en present. 9Herod kon ask Jesus many kweshon, but Jesus nor ansa am at-all. 10Di priest oga dem and di law tishas dey akuiz Jesus with vexnashon. 11Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate. 12Dat day, Herod and Pilate kon bi friends, bikos before dis time dem bi strong enemy.
Dem Take Jesus Go Meet Di Pipol
13Den Pilate koll di priest oga dem, di eldas and di pipol for dat place 14kon tell dem, “Una bring dis man kom meet mi sey e dey deceive pipol. Wen I ask am kweshon for una present, I nor si any bad tin wey una sey e do. 15Even Herod nor still si anytin too, so e sey make dem bring am kom meet us. Dis man nor do anytin wey go make am die. 16So I go give orda make dem flog am, den I go free am.” 17(Na dia tradishon sey Pilate must release one prisona anytime wen dem dey do Passova Feast.)
18But all of dem kon dey shaut, “Take dis man komot! Na Barabas wi wont!” 19(Barabas na pesin wey dem put for prison bikos e kause wahala and kill pesin for di town.)
20Pilate kon tok to dem again, bikos e won free Jesus. 21But dem still dey shaut, “Kill-am trowey, Kill-am trowey!”
22Again Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do? I nor si any bad tin wey e do wey go make am die, so I go give orda make dem flog am, den I go free am.”
23But dem shaut more-more dey sey, “Kill-am trowey.” Dem shaut sotey Pilate kon do wetin dem wont. 24So Pilate orda en sojas sey make dem give Jesus to di pipol make dem go kill-am. 25E kon free Barabas, wey di pipol wont, wey dem bin put for prison, bikos e kause wahala and kill pesin for di town.
Dem Nail Jesus For Cross
26As dem dey take Jesus komot, dem kon katch one man wey dey kom from Sirene and en name na Simon. Dem put di cross for en back make e karry am follow Jesus. 27Many pipol follow Jesus and di wimen among dem kon dey kry. 28But Jesus turn look dem sey, “Jerusalem wimen, make una nor kry bikos of mi, but make una kry for unasef and for una shidren. 29Bikos true-true, di time dey kom wen pipol go sey, ‘E good well-well for wimen wey nor born or feed pikin at-all!’ 30Den,
“dem go tell di mountins, ‘Make yu fall on-top us!’
And tell di hills, ‘Make yu kover us!’
31But if dem do dis kind tin for wood wen e still fresh, wetin go happen wen di wood don dry?”
32Dem still take two oda men wey bi tif, wey dem wont kill, follow Jesus. 33Wen dem rish di place wey dem dey koll, “Di Skull,” dem kon nail Jesus for cross with di two tif, one for en left and di oda for en rite side. 34(Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.
35Di pipol still stand der dey look, but dia leaders dey laf Jesus sey, “E save oda pipol. Make e save ensef if e bi di Mezaya wey God choose!”
36Di sojas still dey laf Jesus and dem kon gi-am wine wey don sawa make e drink, 37den sey, “If yu bi di Jew pipol king, make yu save yorsef!”
38Dem kon rite on-top en cross sey, “Dis na, ‘Jew Pipol King.’ ”
39One of di tif dey shaut for Jesus, “Nor bi yu bi di Mezaya? Make yu save yorsef and us naw!”
40But di oda tif kon shaut for di first tif, “Yu nor dey fear God as e bi sey na di same ponishment wi dey sofa? 41Na dis ponishment fit us, bikos na wetin wi do naim make dem dey ponish us so. But dis man nor do any bad tin.”
42Den e tell Jesus, “Wen yu rish yor kingdom, make yu remember mi!”
43Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today yu go dey with mi for paradise.”
44By naw, twelf oklok don nearly rish for aftanoon and darkness kover di whole kountry until three oklok for dat aftanoon, 45bikos sun stop to shine. Di Temple curtain kon tear into two. 46So, Jesus shaut, “Papa, I put my spirit for yor hand!” Afta e tok finish, e kon die.
47Wen di soja oga si wetin happen, e kon praiz God sey, “True-true, dis man na good pesin!” 48So wen all di pipol wey gada dey look si wetin happen, dem kon dey kry go dia house. 49And evribody wey know Jesus before, stand for far and di wimen wey follow Jesus kom from Galilee, si di tins wey happen.
Dem Beri Jesus
50E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom. 51(E nor gri with di oda kansol membas with dia plan and for wetin dem do so.) 52E go meet Pilate kon ask for Jesus dead body. 53Den e karry di body from di cross, wrap am with linen klot kon put am for di grave wey e dig inside rock, where dem neva beri anybody put before. 54Dat day na Friday wen dem dey ready for Sabat Day serimony.
55Di wimen wey follow Jesus from Galilee kon follow Josef go si di grave. So dem put Jesus body inside. 56Den di wimen go house go prepare betta perfume. But for Sabat Day, dem kon rest as Moses Law tok.

Currently Selected:

Luke 23: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in