YouVersion Logo
Search Icon

John 5

5
Jesus Heal Man Wey Nor Fit Waka
1Jesus kon go one feast wey dem dey do for Jerusalem. 2One pool dey der wey near di Sheep Gate, di name na Betsaida for Aramaik language. Na five roads pipol take dey enter inside. 3Pipol wey nor well, wey blind and doz wey nor fit waka dey liedan for di difren roads. 4From time to time, one angel dey kom shake di wota and anybody wey first enter di wota afta di angel don shake am, go well. 5One man dey der wey nor fit waka for thirty-eight years. 6Wen Jesus si am liedan for der, e kon know sey di man neva fit waka for long time. So, Jesus kon ask am, “Yu won waka?”
7Di man ansa am, “Oga God, I nor get anybody wey go put mi inside di pool wen di wota dey shake. Anytime I dey try to enter di wota, anoda pesin go kwik enter before I rish der.”
8Jesus tell am, “Make yu get up! Karry yor mat make yu bigin waka.” 9At wons, di man get up, karry en mat kon bigin waka. (Dat day na Sabat). 10Den di Jew oga dem kon tell di man wey dey waka naw sey, “Today na Sabat, yu nor suppose to karry yor mat dey waka.”
11Naim e ansa dem, “Di man wey make mi well, tell mi sey, ‘Make I karry my mat and make I bigin waka.’ ”
12Dem kon ask am, “Who bi di man wey sey, ‘Make yu karry yor mat, make yu dey waka?’ ”
13But di man nor know who e bi, bikos Jesus don komot der and plenty pipol dey for dat place.
14Afta dis, Jesus kon si di man inside di temple. So e kon tell am, “Look, yu don well naw, make yu nor kommit sin again, oda-wise, di tin wey bad pass wetin do yu before, go happen to yu.” 15Di man kon go tell di Jew oga dem sey, “Na Jesus bi di pesin wey make mi well.”
Jesus Ansa Di Jew Oga God Dem
16Bikos Jesus dey do all dis tins for Sabat Day, di Jew oga dem kon dey make trobol with am. 17So e tell dem, “My Papa dey work evritime and na so mi too dey work.” 18Bikos of dis, di Jew oga dem kon dey try to kill-am, bikos dem sey e dey break di Sabat law and e dey koll God en papa, like sey en and God na mate.
19Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too. 20Bikos di Papa get strong love for en pikin, e dey always show am evritin wey e dey do and e go show am plenty tins wey pass dis one and una go sopraiz. 21As di Papa get pawa to take wake pesin wey don die, na so too di pikin get pawa to give life to anybody wey en won give. 22Di Papa nor dey judge anybody, but e don give en pikin pawa to judge evribody, 23so dat evribody go bow down for di pikin as dem dey bow down for di Papa. If anybody nor bow show respet for di pikin, e nor go get di mind to respet di Papa wey send di pikin kom.
24“I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end. 25I tell una true word, di time dey kom and e don even rish groun naw, wen doz wey don die go hear Man Pikin vois and wen dem hear am, dem go wake-up and dem nor go die again. 26Bikos as di Papa get life for inside am, na so e give en pikin life too. 27Di Papa don give en pikin di pawa to judge pipol.
28“So, make dis word nor sopraiz una, bikos di time dey kom, wen all doz wey dey inside grave go hear di pikin vois, 29and di angels go kon separate di pipol wey do good tins, so dat dem go enter life wey nor dey end, but God go kondemn di pipol wey dey do bad tins. 30I nor go fit do anytin with my own pawa, but na wetin I dey hear from my Papa, naim I dey use take judge. Any judgement wey I give, na true one, bikos I nor dey do my own tin, but I only dey do as my Papa send mi.
31“If I tok about mysef, e fit bi sey wetin I tok nor bi true”, 32bikos anoda pesin dey wey go tok about mi and I know sey wetin e tok about mi, na true.
33“Una don send message go meet John and e don tell una true word. 34(I nor dey trust wetin pipol tok, but I dey tell una dis word make God for save una.) 35John lite shine well-well for small time and una happy wen una si en lite.”
Jesus Tok About Ensef
36But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi. 37And my Papa wey send mi, en ensef don bear witness about mi. Una neva hear my Papa vois or si am before. 38En word neva still dey inside una, bikos una nor bilive sey na-im send mi. 39Una dey read God word well-well, bikos una bilive sey na wetin una read, go give una life wey nor dey end and na dis same word dey tok about mi, 40but una nor ready to kom meet mi, so dat una go get life wey nor dey end.
41“I nor like make pipol dey praiz mi, 42bikos I know sey, una nor love God for inside una heart. 43I kom with my Papa name and una nor gri asept mi, but if anoda pesin kom with en own name, una go asept am. 44How una go fit bilive wen una dey praiz each oda and una nor kare for di praiz wey only God fit give.
45“Make una nor tink sey I go akuiz una before my Papa. Di tin wey go stand against una na di law wey Moses rite, wey una dey put hope for. 46If una bilive wetin Moses rite for di law, una suppose to bilive mi too, bikos na mi e rite about. 47But if una nor bilive wetin Moses rite, how una go take bilive wetin I dey tell una naw?”

Currently Selected:

John 5: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in