YouVersion Logo
Search Icon

John 4

4
Jesus And En Disciples Komot For Judea
1Jesus kon know sey di Farisee pipol don hear sey e dey baptize plenty pipol pass John and di pipol dey follow am, 2(aldo nor bi Jesus ensef dey baptize pipol, but na en disciples dey do am).
Jesus Tok With Di Woman From Samaria
3Jesus komot for Judea dey go Galilee.
4For am to rish der, e go must pass thru Samaria. 5E kon rish one town for Samaria wey dem dey koll Saikar, wey near di land wey Jakob give Josef, wey bi en pikin. 6Jakob well dey der too. Dat aftanoon, bikos Jesus don taya to waka, e kon sidan near di well.
7So one woman for di town kom draw wota for di well. Jesus tell am, “Abeg give mi wota make I drink.” 8By dis time, en disciples don go inside di town go buy food.
9Den di woman kon tell Jesus, “How yu wey bi Jew kon dey ask mi wey bi Samaria pesin, sey, ‘Make I give yu wota drink?’ ” (E tok dis one bikos Jew and Samaria pipol nor dey gri at-all.)
10Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”
11Di woman ask am, “Oga God, yu nor get bucket and di well deep well-well, where yu go fit get dat kind wota? 12Yu big pass awa grand-grand papa Jakob wey give us dis well, where en family and animals dey drink from?”
13Jesus ansa, “Pesin wey drink from dis wota go always dey hongry for wota. 14But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”
15Di woman kon tell am, “Oga God, give mi dis wota, so dat I nor go hongry for wota or kom here kon draw wota again.”
16Jesus tell am, “Go koll yor husband, make two of una kom meet mi.”
17Di woman ansa, “I nor get husband.”
Den Jesus kon tell am, “Yu tok true wen yu sey ‘I nor get husband.’ 18Bikos yu don marry five husband before and di man wey yu dey stay with naw, nor bi yor real husband. Na true yu tok.”
19Di woman kon tell am, “Oga God, I si sey yu bi profet wey dey tok wetin go happen. 20Awa papa dem serve God for dis mountin, but una kon tok sey, di place wey pipol suppose to woship God, na Jerusalem e dey.”
21Jesus kon sey, “Woman, make yu bilive mi, di time dey kom, wen pipol go woship God for anywhere wey dem dey, nor bi only for dis mountin or for Jerusalem. 22Una dey serve wetin una nor know, but wi dey serve wetin wi know, bikos na Jew pipol, naim God first koll to ensef. 23But di time dey kom and e don even rish, wen di pipol wey won really serve God, go serve am for di true way, wey God Spirit go show dem. 24God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”
25Di woman ansa, “I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ), wey go save evribody, go kom and anytime wen e kom, e go tell us evritin.”
26Jesus kon tell am, “Na mi wey dey tok to yu so, bi di Mezaya.”
Di Disciples Kom Back
27Wen Jesus dey tok to di woman, en disciples kon kom back. Dem sopraiz sey e dey tok with one woman, but dem nor fit ask am, “Wetin e wont?” or “Why e dey tok to di woman?”
28By dis time, di woman don leave en pot wey e take kom draw wota kon run go inside di town go tell pipol sey, 29“Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do. Dis man nor bi di Mezaya so?” 30So di pipol kom out for di town go meet Jesus.
More Workers For Di Harvest
31By dis time, di disciples kon beg am, “Tisha, make yu chop sometin naw.”
32But e tell dem, “I get food wey I go chop wey una nor know about.”
33Di disciples kon dey ask demsef, “Abi somebody don bring sometin for am to chop wen wi nor dey here?”
34Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi. 35Nor bi una dey tok sey, ‘Na for monts remain before dem go plok fruit wey dem plant for farm?’ Make una look round and una go si sey fruit don ripe rish to plok. 36God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go happy togeda. 37Dis one show sey, di tin wey pipol dey tok sey, ‘One pesin plant and anoda pesin plok di fruit’, na true word. 38I send una go plok wetin una nor plant. Oda pipol don sofa plant dem, but una kon enjoy wetin dem sofa for.”
Samaria Pipol Kon Meet Jesus
39By dis time, many pipol from Samaria town kon bilive am, bikos of di tins wey di woman tok, “E tell mi all di tins wey I don do.” 40Wen Samaria pipol kom meet am, dem kon dey beg am sey, make e stay with dem. So e kon stay der for two days, 41and bikos of wetin e tok, many pipol kon bilive am.
42Den dem kon tell di woman, “Nor bi wetin yu tell us make us bilive, but bikos wi don take awa own ear hear and wi don know sey, dis pesin true-true, na-im go save all di pipol wey dey dis world.”
43Wen two days pass, Jesus komot from der go Galilee. 44(Bikos Jesus don tok am sey, “Pesin wey bi profet nor dey get respet for en home-town”). 45Wen e rish Galilee, di pipol wey dey der kon welkom am, bikos dem don si all di tins wey e do for Jerusalem for di time wen dem dey do Passova Feast.
Jesus Heal Soja Oga God Pikin
46Again, e go Kana wey dey Galilee, for where e first turn wota to wine. For Kapanaum, one soja-man wey dey work for di king palis dey der and en pikin wey nor well. 47Wen e hear sey Jesus don kom back to Galilee, e go meet am kon beg am sey make e kom heal en pikin wey won die.
48So Jesus ask am, “If una nor si signs and wonders una nor go bilive mi?”
49Di man ansa, “Oga God, abeg make yu kom before my pikin go die.”
50Jesus kon tell am, “Make yu go house, yor pikin nor go die.”
Di man bilive wetin Jesus tell am, so e kon komot go en house. 51Wen e don near house, en savants kon meet, tell am sey, “Yor pikin don well, e nor die.” 52So, e ask dem di time wen di pikin bigin dey betta. Dem kon tell am, “Na yestiday for one oklok for aftanoon naim e well.”
53Bikos of wetin dem tok, di pikin papa kon remember sey dat na di time wen Jesus tell am sey, “Yor pikin nor go die.” Bikos of dis, di man and evribody wey dey en house kon bilive Jesus.
54Dis na di sekond mirakle wey Jesus do for Galilee, afta e kom back from Judea.

Currently Selected:

John 4: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy