YouVersion Logo
Search Icon

John 18

18
Judas Sell Jesus
1Afta e don tok finish, Jesus and en disciples komot cross go Kidron Valley kon enter one big farm.
2(Judas, wey sell Jesus, know di place, bikos Jesus don go der with en disciples many times). 3So Judas kon escort many soja, some Temple polise and Farisee pipol enter di farm. Dem whole lamp, tosh and some whole swod and stik for hand.
4Bikos Jesus know evritin wey go happen to am, e kon ask dem, “Who una dey find?”
5Dem ansa am, “Na Jesus wey kom from Nazaret.”
E kon tell dem, “Na mi bi di pesin.” (Judas wey sell am, stand der with dem). 6So wen Jesus don tell dem sey, “Na mi bi di pesin”, dem dress go back kon fall for groun.
7Den Jesus ask dem again, “Who una sey una dey find?”
Dem ansa, “Na Jesus wey kom from Nazaret.” 8Jesus kon sey, “I don tell una sey na mi bi di pesin. Since na mi una dey find, make una allow dis men go.” 9(E tok dis word make e bi sey wetin dem rite for God word na true, “I nor lost anybody among di sheep wey yu give mi.”)
10Den Simon Pita bring en swod out kon kut di High Priest savant rite ear komot. (Di savant name na Malkus).
11Jesus kon tell Pita, “Make yu put yor swod back for where e dey before! Yu nor know sey I go drink from di sofa cup wey my Papa give mi?”
12Den di sojas with dia oga and di Jew oga dem take Jesus kon tie am with rope. 13Dem take am go meet Annas, Kaiafas fada-in-law, wey bi di High Priest for dat year. 14(Dis na di Kaiafas wey advise di Jew oga dem sey, “E good make one man die for evribody”).
Di First Time Wey Pita Deny Jesus
15Simon Pita with anoda disciple kon follow dem as dem dey take Jesus go meet Annas. (Di oda disciples know di High Priest well-well, so e follow Jesus enter inside di High Priest kompond). 16But Simon Pita stand outside di kompond near di door. Den di oda disciple wey know di High Priest kom out kon tok to di savant girl wey dey guide di gate and e kon allow Pita enter inside.
17Di girl wey dey di gate kon ask Pita, “Yu nor bi one of dis man disciple?”
At wons, Pita ansa, “I nor bi one of dem.”
18For dis time, all di savant and guards gada round shako fire wey dem make to warm demsef, bikos kold strong well-well. Pita follow dem stand der dey warm ensef too.
Annas Ask Jesus Kweshon
19As dem dey der, di High Priest bigin dey ask Jesus kweshon about en disciples and wetin e tish.
20Jesus kon ansa am, “Na for publik I tok wetin I tish. Na inside sinagog and Temple where all di Jew pipol dey gada, na der I for dey tish. I nor tok anytin for sekret. 21Why yu dey ask mi? Make yu ask di pipol wey hear mi. Dem know wetin I tok.”
22Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”
23Den Jesus sey, “If wetin I tok nor korrect, make yu tell mi, but if e korrect, why yu slap mi?” 24Den Annas kon send am as dem still tie am with rope, go meet Kaiafas, wey bi di High Priest.
Pita Deny Jesus Again
25As Simon Pita stand for inside di kompond dey warm ensef, dem kon ask am, “Yu too nor bi one of en disciple?”
Pita deny sey, “I nor dey among dem.”
26One High Priest savant, wey bi di same family with di man wey Pita take swod kut en ear kon sey, “I nor si yu with am for inside di farm?” 27Pita deny again for dia front and fawol kon do “Kukuruku.”
Jesus Stand For Pilate Front
28Den, dem take Jesus komot from Kaiafas place go di Roman Govnor palis. (By dis time, morning don rish). Dem nor gri enter inside di govnor house, make dem nor for dirty as dia tradishon tok, so dat dem go fit chop di Passova food. 29So Pilate kom meet dem for outside kon ask dem, “Wetin una sey dis man do?”
30Dem ansa, “If to sey dis man nor bi criminal, wi nor for bring am kom meet yu.”
31Den Pilate tell dem, “Make una go judge am as una law tok.”
Di Jew oga dem kon sey, “Awa law nor give us pawa to kill anybody.” 32(Dis tin happen to show sey wetin Jesus tok about how e go die, na true).
Pilate Ask Jesus Kweshon
33So Pilate go inside en house for di palis, kon koll Jesus ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?”
34Jesus ansa am, “Na from yor mind yu ask dis kweshon, abi pipol don tell yu about mi?”
35Pilate kon sey, “Yu know sey I nor bi Jew, abi? Na yor pipol and priest oga dem bring yu kom meet mi. Wetin yu do sef?”
36Jesus ansa, “My kingdom nor dey dis world. If to sey my kingdom dey dis world, my savants for fight make I nor kom meet di Jew oga dem. But as e bi so, my kingdom nor dey here.”
37Den Pilate ask am, “So yu bi king?”
Jesus ansa, “Na yu tok so and yu dey korrect sey, I bi king. Na dis make dem born mi and naim make mi kom dis world kon tok di trut. Anybody wey wont hear di trut, go listin to wetin I dey tok.”
38Pilate still ask am, “Wetin bi di trut?” Den e go outside again go meet di Jew oga dem kon tell dem, “I nor si any bad tin wey dis man do o-o. 39But as una custom sey make I free one prisona for una for Passova, una wont make I free Jesus, wey bi di Jew king?”
40Den, dem kon dey shaut, “Wi nor wont dat man, na Barabas wi wont and na criminal dis Barabas bi.”

Currently Selected:

John 18: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in