Judges 21
21
Wifes For Benjamin Tribe
1Wen Israel pipol gada for Mizpa, dem kon vow sey, “Wi nor go ever marry awa dotas give Benjamin tribe.”
2So dem go Bethel, sidan for God present till evening kon dey kry well-well. 3Dem sey, “Awa Oga wey bi Israel God! Wetin make dis kind tin happen for Israel? Naw one of awa tribe don dey miss from Israel!”
4Di next day for early morning, di pipol build altar kon bring dia burnt and peace ofrin kom.
5Den dem sey, “Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?” By dat time, dem don swear before God sey, anybody wey nor gri kom, dem go kill-am.
6So Israel pipol kon dey sorry for dia broda, Benjamin tribe den dem kon sey, “Today, Israel don lost one of en tribe. 7How wi go fit take find wife for di pipol wey remain, since wi don swear with God sey, wi nor go give dem awa dotas marry? 8Na dis make us ask sey, ‘Wish tribe for Israel nor dey with us wen wi gada for God present for Mizpa?’ ” Den dem kon notis sey, Jabesh nor follow dem gada for Mizpa. 9Bikos wen dem kount all di pipol finish, dem si sey nobody for Jabesh dey der.
10So di pipol kon send anoda 12,000 for dia best sojas go Jabesh town for Gilead sey, make dem kill evribody, even di wimen and shidren. 11Dem sey, dis na wetin una go do, “Kill all di sons and any woman wey nor bi virgin.” 12For all di pipol wey dey Jabesh, dem si 400 yong virgin wey neva sleep with man before kon bring dem kom di kamp for Shiloh wey dey Kanaan land.
13Den di pipol send message go give di pipol wey remain for Benjamin tribe, wey dey stay for Rimon Rock. 14So Benjamin men go back to dia house and Israel pipol kon give dem di girls from Jabesh wey dem nor kill make dem marry. But dem nor many rish.
15Di pipol sorry for Benjamin pipol, bikos God don separate dem from di oda Israel tribes. 16So di leaders kon ask, “How wi fit take find wife for di pipol wey remain, since all Benjamin wimen don die finish? 17Bikos doz wey survive for Benjamin tribe must get shidren, so dat one tribe for Israel nor go die finish. 18But wi nor go fit marry awa dotas give dem, bikos wi don swear sey anybody wey do am go dey under God curse.” 19Den, dem tink of di sakrifice wey dem dey do for God and na evry year for Shiloh, wey dey sout for Lebonah and nort for Bethel, dem for dey do am. E still dey east for di road wey dey between Bethel and Shekem.
20So dem tell Benjamin men wey still nid wife sey, “Make una go hide for di vineyards. 21Anytime una si di yong wimen for Shiloh kom out kon dance for di festival, una go rush kom out kon katch dem one-by-one go house for Benjamin town as una wife! 22Den wen dia papa and brodas kom meet us with vexnashon, wi go tell dem sey, ‘Abeg make una sorry for us. Make una allow dem marry una dotas, bikos wi nor fit find wife for all of dem wen wi distroy Ramot. And nor-tin go do una if una break di vow, bikos una nor really marry una dotas give dem from una mind.’ ”
23So Benjamin men do as dem tell dem. Each man katch one woman as dem dey dance for di festival kon karry am go as en wife. Dem go back to dia own land kon build house and stay der again.
24Den Israel pipol komot from der. Evry man go back to en tribe, family and evritin wey e get.
25For dat time, Israel nor get king; so evribody dey do wetin dem tink sey dey good for dia eye.
Currently Selected:
Judges 21: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee