Judges 19
19
Di Levi Priest And En Girl-friend
1For dat time, Israel pipol nor get king. But e get one man from Levi tribe wey dey stay for Efraim hill kountry. One day, e bring one girl kom from Betlehem for Judah as en girl-friend. 2But di girl dey vex for am, so e kon go back to en papa house for Betlehem. Afta four monts don pass, 3en boy-friend kon go Betlehem go tok to am make e kom back. E take en savant and two donkey follow body. Wen e rish di girl papa house, di papa kon welkom am. 4Di papa beg am make e stay small, so e stay der; chop, drink and sleep for three days.
5For di fourt day, di man kwik wake-up kon ready to go, but di girl papa tell am, “Make yu chop sometin, before yu go.” 6So di two men sidan kon chop and drink, den di papa kon sey, “Abeg stay for just dis nite make yu enjoy yorsef.” 7Di man stand up won kon go, but di papa still dey beg make e stay, so e kon agri to stay for dat nite. 8For di fift day, e kon kwik wake-up make e dey go. Again, di girl papa kon sey, “Make yu chop sometin; den yu fit go for aftanoon.” So dem sidan kon chop.
9Afta, wen di man, en girl-friend and en savant dey ready to go, di papa kon sey, “Look, evening don almost rish. Make una stay and enjoy for dis nite, den tumoro morning, una fit get up early kon go.” 10But dis time, di man don make up en mind to go. So e take en two donkey and en girl-friend kon pass thru Jebus (wey bi Jerusalem).
11Time don go far before dem rish Jebus, so di man savant tell am, make wi stop for Jebus town kon sleep for der.
12But di masta sey, “No! Wi nor go fit stay for dis town wey Israel pipol nor dey, instead wi go-go Gibeah. 13Make wi waka fast, so dat wi go fit rish Gibeah or Rama, den wi go sleep for any of di towns.” 14So dem kontinue. Evening don dey rish wen dem rish Gibeah town for Benjamin land, 15so dem stop kon sleep for der. Dem sleep for di town hall, bikos nobody allow dem sleep for dia house.
16Dat evening, one old man just dey kom back from farm where e for go work. E kom from Efraim tribe, but e dey stay for Gibeah, wey all di pipol kom from Benjamin tribe. 17Wen e si dem sidan for di town hall, e kon ask dem, “Where una from kom and where una dey go.”
18Di Levi man ansa, “Wi dey kom from Betlehem for Judah and wi dey go di oda side for Efraim hill kountry, bikos na der wi dey stay. I travel go Betlehem before and naw I dey go back to my house. But nobody gri make wi sleep for dia house dis nite, 19even doh sey wi get evritin wey wi wont. Wi get food for awa donkey, plenty bread and wine for awasef.”
20Den di old man sey, “Make una kom my house, I go give una anytin wey una wont. Una nor nid to stay for di town hall.” 21So e take dem go en house kon feed dia donkey. Afta dem don wosh dia leg, dem kon chop and drink togeda.
22As dem dey chop and drink, some pipol wey dey kause trobol for di town kon surround di house. Dem bigin nok di door dey shaut for di old man, “Make yu bring di man wey dey stay with yu, so dat wi go sleep with am.”
23But di old man go outside go meet dem kon tell dem, “No! My brodas, abeg make una nor do dis kind evil tin! Dis man na my visitor and dis kind tin na shame. 24Look, make una take my dota wey bi virgin and di man girl-friend. I go bring dem kom out for una, make una take dem do wetin una like, but make una nor do dis kind bad tin to di man.”
25But dem nor gri listin to di man. So di Levi kon push en girl-friend go outside for dem. So dem rape am, do am anyhow till day break. 26Wen day break, di woman kom di old man house where en boy-friend dey kon fall for di gate, e stay der until sun kom out for morning.
27Wen di boy-friend open door for morning make e dey go, e si en girl-friend liedan for der and e hand dey di door-mot. 28So e tell am, “Make yu get up make wi dey go!” But di woman nor ansa. So e karry am put for en donkey kon take am go house.
29Wen e rish house, e take knife kon kut en girl-friend body into twelf part, den e send one part go each of di twelf tribe for Israel. 30Evribody wey si am kon sey, “Wi neva hear dis kind tin before! Dis kind tin neva happen wons since Israel pipol komot from Egypt! Wi nid to do sometin about am! So dem kon dey tok among demsef dey ask, ‘Na wetin wi go do naw?’ ”
Currently Selected:
Judges 19: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee