YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 6:1-4

Jenesis 6:1-4 PCM

Wen human being don plenty for di world and dem kon dey born girls, some among God sons kon si as woman fine rish. So dem kon dey marry dem as wife. So Oga God kon sey, “My Spirit nor go fit stay with man again pass one hundred and twenty years, bikos dem bi ordinary human being.” Before-before and even leta, Nefilim pipol (giant pipol) dey for di eart and na God sons born dem wen dem dey sleep with ordinary wimen. Na dem bi di wariors wey pipol bin know for evriwhere.