YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 49

49
Jakob Blessing
1Den Jakob koll all en sons kon sey, “Make all of una kom, so dat I go tell una wetin go happen for future.
2“Make una listin to mi, una wey bi Jakob shidren;
make una listin to Israel wey bi una papa.
3Reuben, na yu I first-born,
my strent and di first fruit wey I plok.
Na yu bi di nomba one,
both for rank and pawa.
4But yu dey skata tins like wota,
so yu nor go prosper,
bikos yu sleep with yor papa wife for my bed!
5Simeon and Levi na brodas,
dem like war and trobol well-well!
6Make I neva ever join dia meetin
or go where dem for gada dey make plan.
Bikos as dem dey vex,
dem kill many pipol
kon break animals leg just as dem like.
7I curse dia wiked mind,
bikos e too strong and dia annoyance,
bikos e dey bad well-well.
I go divide dem inside Jakob family
kon skata dem among Israel pipol!
8Yu Judah, yor brodas go praiz yu.
Yor hand go strong pass yor enemy own.
Yor papa sons go bow down for yu.
9Judah my pikin,
yu bi yong lion
wey just chop wetin e kill finish.
Yu dey kill like lion
kon kwayet dey look;
yu bi like woman lion,
na who go fit fight am?
10Di pawa rod nor go komot from Judah
and di pawa to take rule,
go always dey en leg,
until e go rish di pesin wey really get am
and evribody go obey yu.
11E tie en donkey put for di vine,
di vine wey e choose.
Na wine e take dey wosh en klot
and na grape e take dey wosh en garment.
12En eyes dark pass wine
and en tit white pass milk.
13Zebulun go dey stay near di sea
and e go dey kontrol many sheep for di sea,
en land go long go rish Sidon.
14Issakar na very strong donkey
wey dey rest on-top two strong bags.
15Wen e si how di kountry side bi
and how di land good,
e go fit bear di load wey e karry
kon bi savant to odas.
16Dan go rule pipol
like any oda tribe for Israel.
17Dan go bi like snake wey dey di road korna;
like betta wiked snake wey dey bite horse leg,
so dat who dey ride am go fall.
18My Oga God, I trust Yu sey, Yu go save mi!
19Pipol wey dey tif, go attack Gad,
but e go attack dem wen dem don go back.
20Na rish-rish food Asher go dey chop
and e go dey provide betta food for kings.
21Naftali go bi like animal wey dey free;
di words wey e go tok,
go dey good well-well.
22Josef na betta vine wey dey produce good food;
betta vine wey dem plant near wota
and en branches dem dey klimb di wall.
23Hunta go attack am,
dem go shot and oppoz am.
24But en bow go dey strong
and e nor go move
and e hand go sabi work
bikos of Jakob God, di Shepad,
wey bi di Rock for Israel,
25una papa God wey go help una,
di God wey get pawa wey go bless una
with di blessing wey dey di sky for up;
di Pesin wey get blessings wey dey wota
and under di eart and even di ones from animals.
26Una papa blessing dey great pass
all di blessings wey
dey from di mountins go rish di hills.
Dis blessings go rest for Josef head,
bikos e bi prince among en brodas.
27Benjamin go bi like wolf
wey dey skata en enemy.
For morning, e dey distroy wetin e katch
and for evening, e dey divide wetin e katch.”
28Dis na di twelf tribes for Israel. Dis na wetin dia papa tell dem wen e dey bless dem. E bless all of dem as e suppose bless dem.
Jakob Die
29Den Jakob kommand sey, “I go soon die. So, make una beri mi with my papa dem for di grave wey dey Efron field for Hit land. 30Na di grave wey dey Makpelah field for Mamre land for Kanaan, wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin. 31Na der dem for beri Abraham and en wife Sarah; na der two dem for beri Isaak and en wife Rebekah and na der I for beri Leah. 32Dem buy di field and di grave wey dey inside from Het shidren.” 33Wen Jakob don kommand all en sons finish, e karry en leg well enter di bed, breath en last breath, den e kon die.

Currently Selected:

Jenesis 49: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in