YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 48

48
Manasseh And Efraim
1Afta dis, dem kon tell Josef, “Yor papa nor dey strong again.” So e take en two sons, Manasseh and Efraim go meet am. 2Wen dem tell Jakob sey, “Yor pikin Josef don kom meet yu,” e kon get up sidan for en bed.
3Jakob tell Josef, “Di God wey get pawa appear to mi for Luz wey dey Kanaan land kon bless mi. 4E tell mi sey, ‘I go make yu get shidren and propaty and dem go many well-well. I go make many nashons kom from yu and I go give dis land to yor shidren-shidren as dia own forever.’ 5Naw, koncerning yor two pikin wey yu born for Egypt before I kom here, dem go mi my own. Just as Efraim and Manasseh bi my own, na so Reuben and Simeon go bi my own too. 6But any pikin wey yu go born afta dem, go bi yor own; wen dem won share di propaty for di promise land, dia name go dey under Manasseh and Efraim name. 7But for mi, wen I dey kom back from Paddan, Rashel die kon make mi kry for Kanaan. E die for road, wen wi still dey far from Efratah. So I beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).”
8Wen Jakob si Josef sons, e kon ask, “Na who bi dis?”
9Josef tell en papa, “Dem bi di pikin wey God don give mi for dis place.”
En papa kon sey, “Bring dem kom meet mi, so dat I go bless dem.”
10For dis time, Jakob nor dey si well again, bikos e don old well-well. So Josef take en sons near am well-well and en papa hold dem near en body kon kiss dem. 11Israel tell Josef, “I nor bilive sey I go si yu again, but naw, God don let mi even si yor shidren too.”
12So Josef take dem komot from Israel leg kon bow face groun. 13Josef arrange dem; e use en rite hand take direct Efraim go Jakob left hand kon use en left hand direct Manasseh go Jakob rite hand. Den Josef take dem go meet en papa. 14Israel take en rite hand put am on-top Efraim head, even doh na en bi di yonga one. As e cross en hand, e kon put di left hand on-top Manasseh head, but na Manasseh bi first-born.
15Den Israel bless Josef kon sey,
“Make di God wey yor grand-papa
Abraham and Isaak serve;
di God wey dey guide mi
since thru-out my life kon rish today;
16di Angel wey don protet mi from all wahala,
bless dis boys.
My name and my papa Abraham and Isaak name
go shine for dia life.
Dia shidren go many
like san-san for dis eart.”
17Wen Josef si sey en papa put en rite hand for Efraim head, e nor happy. So e try remove en papa rite hand from Efraim head go Manasseh head. 18Josef tell en papa, “My papa, nor bi so, na Manasseh bi first-born, so make yu put yor rite hand for en head.”
19But en papa sey, “My pikin, I know; I know wetin I dey do. Manasseh too go bi strong nashon and e go dey great. But even with all dis, en yonga broda go strong pass am and en shidren-shidren go many like san-san.” 20So Israel bless dem dat day kon sey, “Na thru una Israel pipol go dey bless wen dem sey, ‘Make God bless us like Efraim and Manasseh.’ ”
21Den Israel tell Josef, “Na die I dey so, but God go dey with yu and e go take yu go back to yor papa land. 22Bikos yu dey higher dan yor brodas, I go give yu di low side for di mountin wey I take from Amor pipol with my swod and bow.”

Currently Selected:

Jenesis 48: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in