YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 47

47
Jakob Bless Fero
1Josef kon go tell Fero sey, “My papa, my brodas, dia animals and evritin wey dem get don kom from Kanaan. Dem dey for Goshen.”
2Josef take five among en brodas kon introduce dem to Fero. 3Fero kon ask Josef brodas, “Na wetin una dey do.”
Dem ansa, “Yor savants dey kare for animals, just as awa grand-grand papa dem do.” 4Den dem tell Fero, “Wi just won stay for dis land for sometaim. Wi nor get food for awa animals, bikos of di honga for di whole Kanaan. So wi beg, make yu let wi yor savant stay for Goshen.”
5So Fero tell Josef, “Na yu yor papa and brodas kom meet. 6Egypt dey yor hand, so make yu do as yu like to yor papa and brodas. Dem fit stay for Goshen and if yu know any strong one among dem, yu fit gi-am my animals make e guide dem.”
7Den Josef take en papa Jakob go meet Fero. Jakob kon bless Fero. 8Fero ask Jakob, “How many years yu don spend for dis life?”
9Jakob ansa Fero, “I don stay for more dan one hundred and thirty years. And all di years wey I don spend for dis life nor many, but e nor dey eazy; di years wey I don stay, nor many rish di years wey my grand-grand papa dem stay.” 10Den Jakob bless Fero kon komot from der.
11So Josef make en papa and brodas setol down. E give dem one aria for Egypt, di best aria for di land; wey bi Rameses land, just as Fero tok. 12Josef still provide food for en papa, en brodas, all en papa pipol, akordin to di shidren wey dem get.
Honga Time
13But food nor dey di land again, bikos di honga for evriwhere, strong well-well. So pipol kon die anyhow for Egypt and Kanaan land, bikos food nor dey. 14Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, so Josef kollect and karry all di money go give Fero for en palis. 15So wen Egypt and Kanaan pipol don use all dia money take buy food finish, all di pipol for Egypt kon go meet Josef dey sey, “Make yu give us food! Abi yu wont make wi die for yor front, bikos awa money don finish?”
16Den Josef sey, “If una money don finish, make una bring una animals kon give mi and I go give una food.” 17So dem bring all dia animals kon give Josef and Josef give dem food afta dem don drop dia horse, sheep and kattle. E save dem dat year, bikos e still dey give dem food chop wen dem bring dia animals.
18Wen dat year don finish, dem kon meet am di next year dey sey, “Wi nor fit hide am from awa oga sey di money and all awa animals don finish. 19Wetin go make us die for yor eye; both wi and awa land. Make yu buy wi and awa land and wi and awa land go bi Fero own. Just give us food, so dat wi nor go die. Den di land nor go dey empty.”
20So Josef buy all di land for Egypt kon gi-am to Fero. Evribody for Egypt sell dia field, bikos di honga dey strong evriday. So all di land for Egypt kon bi Fero own. 21So Josef kon make evribody for Egypt turn slave. 22But e nor buy di priests land, bikos di priests get favor from Fero eye, so dem dey chop from di share wey Fero give dem. Dat na why dem nor sell dia land.
23Josef kon tell di pipol, “Since I don buy una and una land for Fero, make una take seed kon go plant for di land. 24Wen una don harvest wetin una plant, make una divide am into ten kon give five part to Fero and una with una family fit chop di rest.”
25Dem ansa, “Yu don save awa life! Yu don show us favor and wi go bi Fero savants.” 26So wetin Josef tok kon bi law for Egypt and dem dey obey am kon rish today: wen dem divide evritin, five part na Fero own. Na only di priests land nor bi Fero own.
Jakob Tok To Josef
27Israel stay for Egypt, for Goshen and dem kon get land for der. 28Jakob stay seventeen years for Egypt; so all di years wey Jakob stay, na one hundred and forty-seven years. 29Di time wey Israel won die kon rish, so e koll en pikin Josef kon tell am, “If really sey yu love mi, make yu put yor hand under my lap kon show mi kindness and faithfulnes. Make yu nor beri mi for Egypt, 30but wen I die, karry mi komot from Egypt go beri for my papa burial groun.” So Josef sey, “Papa! I go do as yu tok.” 31Israel sey, “Make yu promise mi sey yu go do as I tok.” So Josef promise. Den Israel bow face groun for en bed korna.

Currently Selected:

Jenesis 47: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in