YouVersion Logo
Search Icon

Jenesis 46

46
Jakob And En Family Go Egypt
1So Israel kon start en journey and e karry evritin wey e get follow body. Wen e rish Beersheba, e offa sakrifice give en papa Isaak, God. 2Wen Israel dey sleep for nite, God kon tok to am for vishon sey, “Jakob, Jakob!”
E ansa, “Na mi bi dis!”
3God sey, “Na mi bi God, di God wey yor papa serve. Make yu nor fear to go Egypt, bikos na der I go for make yu bi one strong nashon. 4I go follow yu go Egypt and na mi go take my hand bring yu kom back to dis land. Josef go kare for yu till yu die for Egypt.”
5Den Jakob komot from Beersheba and Israel sons put dia papa, dia shidren and dia wifes for di horse wey Fero send kom kon karry dem go Egypt. 6Jakob and all en shidren karry dia animals and propaty wey dem get for Kanaan kon go Egypt. 7Jakob karry en sons and grand sons, en dota and grand dotas and evritin wey e get, enter Egypt.
8Dis na di name of Israel shidren wey follow am go Egypt, dat is Jakob and en sons:
Reuben, Jakob first-born 9Reuben sons na: Hanok, Pallu, Hezron and Karmi.
10Simeon sons na: Jemuel, Jamin, Ohad, Jakin, Zohar and Shaul (di pikin wey one Kanaan woman born for am). 11Levi sons na: Gershon, Kohat and Merari.
12Judah sons na: Er, Onan, Shelah, Perez and Zera (But Er and Onan die for Kanaan land). Perez sons na Hezron and Hamul.
13Issakar sons na: Tola, Puah, Jashub and Shimron.
14Zebulun sons na: Sered, Elon and Jahleel.
15All dis na di shidren wey Leah born for Jakob for Paddan Aram, with Dinah en dota. All en sons and dotas na thirty-three.
16Gad sons na: Zifion, Haggi, Shuni, Ezbon, Eri, Arodi and Areli.
17Asher sons na: Imnah, Ishvah, Ishvi, Beraya and Serah wey bi dia sista. Beraya sons na Heba and Malkiel.
18All dis na di shidren wey Leah savant, Zilpah born. E born dem for Jakob and all of dem na sixteen.
19Jakob wife Rashel born only: Josef and Benjamin. 20Dem born Manasseh and Efraim give Josef for Egypt. Potifara wey bi priest for On, na en dota Asenat born dem for Josef.
21Benjamin sons na: Bela, Beka, Ashbel, Gera, Naaman, Ehi, Rosh, Muppim, Huppim and Ard.
22All dis na Rashel sons wey dem born give Jakob and dem bi fourteen.
23Dan son na: Hushim.
24Naftali sons na: Jahziel, Guni. Jeza and Shillem.
25Dis na di shidren wey Rashel savant, Bilhah born. E born all of dem for Jakob and dem bi seven.
26All Jakob main shidren wey follow am go Egypt, na sixty-six dem bi. (Jakob shidren wife dem nor dey join dis nomba.) 27If wi kount di two sons wey dem born give Josef for Egypt, all di pipol wey Josef get for Egypt kon bi seventy.
Jakob And En Family Stay Egypt
28Jakob kon send Judah for front go tell Josef make e kon follow am go Goshen. So dem kon rish Goshen land. 29Josef klimb en shariot kon go meet en papa Israel, for Goshen. Wen e meet am, e hug am kon bigin kry. 30Israel kon tell Josef, “As long as I don si yor face kon know sey yu dey alive, I fit die naw.”
31Den Josef tell en brodas and evribody wey dey en papa house sey, “I go-go tell Fero sey, ‘My brodas and my papa family wey bin dey for Kanaan, don kom follow mi stay. 32Di men sabi guide animal; dem dey kare for animals well-well. Dem kom with dia animals, plants and evritin wey dem get.’ 33Wen Fero koll and ask una sey, ‘Na wetin una dey do?’ 34Den make una tell am sey, ‘Yor savants dey kare for animals since wi bi small pikin kon rish naw, both wi and awa papa.’ Make una tok like dat, so dat una go fit stay for Goshen land, bikos Egypt pipol nor like pipol wey dey kare for animals.”

Currently Selected:

Jenesis 46: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in