Jenesis 17
17
Di Kovenant Sign
1Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu. 2I go make my kovenant with yu kon give yu plenty shidren.” 3Abram bow face groun and God tok to am, 4“I make dis kovenant with yu: I promise sey yu go bi many pipol papa. 5Yor name nor go bi Abram again, but e go bi Abraham, bikos I dey make yu papa for many nashons. 6I go give yu many shidren and some of dem go bi kings. Yu go get many shidren and dem go get kountries.
7“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God. 8I go give yu and yor shidren dis land where yu dey stay as strenja naw. Di whole Kanaan land go bi yor shidren-shidren own forever and I go bi dia God.”
9God still tell Abraham, “Yu too must gri sey yu go keep di promise wey yu make with mi, both yu and yor shidren-shidren. 10Yu and yor shidren-shidren must agri to sekonsaiz evry boy pikin among una. 11From naw go, yu must sekonsaiz evry pikin wey bi boy, eight days afta dem born am, 12plus yor savant wey bi strenja shidren wey dem go born for here. Dis go show sey mi and yu, get kovenant. 13Una must sekonsaiz evry pikin and dis go bi sign to show sey my kovenant with yu, go bi forever. 14Anybody wey dem neva sekonsaiz, I nor go koll am my own, bikos e neva keep di kovenant with mi.”
15God tell Abraham, “Make yu nor koll yor wife Sarai again; from naw go, en name na Sarah. 16I go bless am and I go make am born boy for yu. I go bless am and Sarah go bi plenty pipol mama and kings go dey among en shidren-shidren.”
17Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?” 18Abraham kon ask God, “Why Yu nor allow Ishmael to bi my only pikin?”
19But God sey, “No! Yor wife Sarah go get belle kon born boy for yu and yu go koll am, Isaak. I go keep my kovenant with am and en shidren-shidren forever. Di kovenant na forever and ever. 20I hear wetin yu tok about Ishmael. I go bless am kon gi-am many shidren. E go bi twelf prince papa and I go make en shidren-shidren great. 21But I go keep my kovenant with yor pikin Isaak, wey Sarah go born for dis time next year.”
22Wen God tok to Abraham finish, E kon leave am. 23For dat same day, Abraham obey God kon sekonsaiz en pikin Ishmael and all di oda boys wey dey en house, plus en savants pikin and doz wey dey with am. 24Abraham na ninty-nine years wen dem sekonsaiz am 25and en son Ishmael na thirteen. 26Na di same day dem take sekonsaiz Abraham, Ishmael 27and all en savants.
Currently Selected:
Jenesis 17: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee