YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 3

3
King Og For Bashan
1Den wi turn kon dey go Bashan and King Og for Bashan kon gada en sojas kom fight us for Edrei. 2But God tell mi, “Make una nor fear, bikos I don give una viktory ova King Og and all en sojas and I go give una all en land. Make una do to am, just as una do to King Sihon for Heshbon town inside Amor.”
3So God make us win King Og for Bashan and all en sojas, den wi kill dem finish. 4For dat time, wi kollect all di towns wey e get. E nor get any town wey wi nor take from dem. Wi take sixty towns and all di aria for Argob wey bi Bashan main kingdom. 5Dem guide all dis towns with high walls, big gates kon lock dem with betta iron key and dem still get many village. 6Wi judge dem well, both wimen and shidren, just as wi judge King Sihon for Heshbon. 7But wi keep all di animal and evry oda tin wey wi karry from di town.
8So for dat time, wi take di two king for Amor land for (Trans-Jordan) go rish River Arnon and Mount Hermon 9(Sidon pipol dey koll am Hermon Sirion, why Amor pipol dey koll am Senir), 10all di towns wey dey di high lands, all di lands for Gilead and Bashan go rish Salekah and Edrei, di towns wey bi King Og for Bashan, own. 11For all Refah pipol, na only King Og for Bashan remain. (Na iron dem take make en bed and e still dey for Rabbah wey dey Ammon. Akordin to how dem dey measure, di bed long rish thirteen and half fit and e wide rish six fit.)
Dem Divide Di Land
12Dis na di land wey wi kollect den: Di aria from Aroer go River Arnon and half for Gilead hill kountries with dia towns, I give dem to Reuben and Gad tribe. 13Di remainin one for Gilead and di land for Bashan and King Og kingdom, I give dem to half for Manasseh tribe. (All di aria for Argob, dat is, all Bashan wey dem dey koll Refah land. 14Manasseh pikin, Jair take Argob aria go rish Geshur and Maakat pipol borda (wey bi Bashan), den e shange di town name to en name. And na Havvot-Jair dem dey koll am till today.) 15I give Gilead to Makir. 16Di aria from Gilead go rish River Arnon (Di main centre) go rish River Jabbok, wey dey Ammon pipol borda, I still give dem to Reuben and Gad tribe. 17Arabah and Jordan River na still borda for Kinneret Sea go rish Arabah Sea (dat is, di Salt Sea), under di low land for Pisgah go rish di east.
18For dat time, I tell dem sey: “Di Oga wey bi una God don give una dis land as una own. Una sojas wey don ready for war go cross first, before Israel pipol go follow for back. 19But una wifes, shidren and animals (Bikos I know sey dem many), make dem stay for di towns wey I give una. 20Una must fight until God make una pipol win, just as E do for una and dem go kollect di land wey God give dem for di oda side for Jordan River. Den una fit go back to una own land wey I don give una.”
21I still kommand Joshua sey, “Yu don si evritin wey di Oga yor God do to doz two kings; E go still do di same tin to all di kingdoms wey yu go-go. 22So make una nor fear, bikos di Oga una God go fight for una by ensef.”
Moses And Di Promise Land
23So for dat time, I beg God, 24“My Oga God, yu don start to show mi yor pawa and how Yu strong rish. (Na wish god for heaven or eart go fit do wetin Yu dey do so?) 25Abeg make Yu let mi cross with Israel pipol, so dat I go si di land wey Yu promise awa grand-grand papa dem for di oda side for Jordan River, wey get betta kountries for di hill and Lebanon!”
26But God vex for mi, bikos of una and E nor gri listin to mi. Instead, E tell mi, “E don do! Make yu nor tok to mi about dat matter again! 27But klimb go Pisgah and make yu look di east, nort, sout and west well-well, bikos I nor go let yu cross Jordan River. 28But yu go make Joshua di leader kon enkourage am, bikos na-im go take dis pipol cross kon make dem get di land wey yu go si.” 29So wi stay for Bet-Peor Valley.

Currently Selected:

Deutronomi 3: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in