YouVersion Logo
Search Icon

Deutronomi 10

10
Anoda Stone
1For dat time, God kon tell mi, “Make yu kut two stones like di first ones den kom meet mi for di mountin; make yu still make box with wood for yorsef. 2Di same word wey dey di stones wey yu break, I go rite dem put for dis ones and yu must put dem for di box.”
3So I use akasia wood take make box kon kut two stone like di first ones. Den I klimb go di mountin with di two stones for my hand. 4So di same word wey bi di ten kommandment wey E tell mi for di mountin and from di fire wen una gada go meet am, God kon rite dem put for dis ones as E bin rite am for di first stones. 5Den I kom down from di mountin kon put di two stones for di box wey I make, just as God kommand mi and di stones still dey der.
Evritin Wey Happen
6For dat time, Israel pipol travel from Beerot Bene Jaakan go Mosera. Aaron die for der and dem beri am and en pikin Eleazar kon take-ova as priest. 7From der, dem travel go Gudgodah kon from der travel go Jotbatah where wota for dey flow. 8For dat time, God separate Levi tribe sey make dem karry God Kovenant Box kon stand for God present to serve am and na dem go dey bless pipol with en name and na so e bi till today. 9Dat na why Levi pipol nor get propaty or land among di oda tribes for Israel. Na God ensef bi dia propaty, just as di Oga una God tok.
10But for mi, I stay for di mountin just as I do for di first time for forty days and forty nite. For dat time, God still listin to mi kon sey E nor go distroy una. 11Den E tell mi, “Make yu and di pipol start una journey, so dat dem go-go kollect di land wey I promise dia grand-grand papa.”
Wetin God Wont
12Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart. 13Una must always obey God kommand and law wey I dey give una today, so dat evritin go dey well with una.
14Di heavens, di heavens wey high pass, plus di eart and evritin wey dey inside am, na God get all of dem. 15Yet God show en love to una grand-grand papa dem. And E choose una wey bi dia grand-shidren above evry oda pipol, as all of us dey si am today. 16So make una shange una heart and stop to dey do strong head. 17Bikos di Oga una God na God of all gods and Oga of all ogas. Na en bi di great Oga God, di God wey dey do wonders, God wey nor dey do wayo and nobody fit bribe am. 18Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear. 19So una too must show love to strenjas, bikos unasef bi strenja for Egypt before. 20Una must fear di Oga una God kon woship and love am. Wen una swear, e go must bi with en name. 21Na only en bi God; di only one wey wi go dey praiz; di Pesin wey don do many wonderful mirakles wey una don si with una own eyes. 22Wen una grand-grand papa dem go Egypt, dem bi only seventy. But naw, di Oga una God don make una plenty like di stars for sky!

Currently Selected:

Deutronomi 10: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in