Acts 5
5
Wetin Happen To Ananias and Saffira
1One man wey dem dey koll Ananias with en wife Saffira kon sell dia land. 2Dem kon gri sey dem go keep some for di money for demsef. So Ananias take di remainin money go give di apostles. 3But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef? 4Before una sell di land, nor bi una own propaty? Naw wen una sell am finish, di money nor still bi una own to spend as una like? Wetin make una get dis kind mind? Dis lie wey yu tok so, nor bi pesin yu do am to, but na God!”
5Wen Ananias hear di word wey Pita tok, e fall for groun at wons kon die. Dis tin make fear katch evribody wey hear wetin happen. 6So di yong men wey dey der, take wrapa kover en body kon karry am go beri. 7Wen three hours don pass, en wife, Saffira waka kom, but e nor know wetin don happen to en husband. 8Den Pita ask am, “Madam, tell mi di trut. Na dis bi di prize wey una sell di land? Saffira ansa, ‘Yes, na-im.’ ” 9So Pita tell am, “Wetin make yu and yor husband decide to try God Spirit like dis? Look! Na di pipol wey go beri yor husband dey kom so and dem go karry yu go beri too!” 10At wons, di woman fall for groun kon die for Pita front. So wen di yong men enter inside di house kon si sey di woman don die, dem karry am go beri near where dem beri en husband put. 11Fear katch di pipol for di church and odas wey hear wetin happen.
Mirakles And Wonders Wey Di Apostles Do
12Na dis kind mirakle and wonder God do thru di apostles for di pipol front and dem kon dey meet for Solomon Varanda. 13Fear nor let anybody wey nor dey among dem go join dem anyhow and e kon make all di pipol dey respet dem well-well. 14But plenty men and wimen wey bilive Jesus Christ kon join dem, 15sotey dem even dey karry pipol wey nor well put for bed and mat for road, so dat as Pita dey pass, en shadow go heal dem. 16Dem bring pipol well nor well and doz wey get evil spirit from all di town and village wey near Jerusalem and God heal all of dem.
Wahala Wey Di Apostles Face
17But jealousy kon full di High Priest and di Sadusi pipol mind, 18so dem kon arrest di apostles put for prison. 19But for dat nite, God angel open di prison door kon bring dem kom out and tell dem, 20“Make una go stand for di temple varanda bigin prish God word wey dey give pipol life.” 21Afta dem hear dis, dem enter di temple varanda for morning kon start to dey tish di pipol.
Den di priest oga dem and di pipol wey dey follow am kon koll di Sanhedrin, wey bi di big kansol for Israel pipol. Dem send pipol go di prison make dem go bring di apostles kom, bikos dem won judge dia kase. 22But di savant wey dem send go, nor si dem for di prison, so dem go back go ripot sey, 23“Wi si sey dem lock di prison well and all di sojas stand for di front, but wen wi open di gate, wi look inside, but wi nor si anybody.” 24So wen di soja oga wey dey di temple and di priest oga dem hear dis tin, dem sopraiz well-well kon dey wonder wetin happen to di apostles. 25Na dat time one pesin kon tell dem sey, “Si o-o, di men wey una put for prison dey for di temple varanda dey tish pipol!” 26So di soja oga wey dey di temple kon escort di savant go bring di apostles, but dem nor use force, bikos dem dey fear sey di pipol wey gada der, fit stone dem.
27Wen dem don bring dem inside, dem kon sey make dem stand for di kansol front and di priest oga dem kon dey kweshon dem. 28E ask dem, “Wi kommand una sey make una nor tish pipol about dis name, but si naw, di whole Jerusalem don full with di tins wey una dey tish. Una won put dis man blood for awa head?” 29But Pita and di apostles ansa, “Wi go must obey God instead of human being. 30Na di God wey awa grand-grand papa dem serve raiz-up Jesus Christ wey una hang for tree. 31But God don promote am sey make e sidan for en rite hand kon gi-am big pozishon as Oga God and di Pesin wey go save di world, so dat Israel shidren go turn from dia sin kom meet God make e forgive dem. 32All of us know sey dis tin na true and di Holy Spirit wey God don give to pipol wey dey obey am, dey still bear witness sey, dis tin na true.”
33Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles. 34Den one Farisee wey dem dey koll, Gamaliel, wey dey tish di law and wey di pipol dey respet well-well kon stand up tok, “Make una send dis men go outside first.” 35Den e kon tok to di kansol, “Una Israel oga, make una tink well before una do anytin to dis men. 36Bikos na so Teudas still kom up before, dey tok sey en na pesin wey dey important and na about four hundred pipol follow am. Wen dem kill-am, all di pipol wey dey follow am skata and evritin kon end. 37Afta am, Judas wey kom from Galilee kom out wen dem dey do census. E push pipol to join am oppoz wetin dem dey do. Dem still kill-am and all di pipol wey dey follow am skata too. 38Naim make I sey for dis matter so, make una remove una hand and leave all dis men, bikos if all di tins wey dem dey plan and do, na from dia mind, dem nor go susid, 39but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.” 40So dem bring di apostles kom back kon tell dia savant make dem flog dem. Afta dem release dem, dem kon warn dem sey make dem nor use Jesus Christ name take prish again. 41So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ. 42So evriday for di temple kompond and from house to house, dem kontinue to dey tish and prish di Good News sey, “Na Jesus Christ bi di Mezaya.”
Currently Selected:
Acts 5: pcm
Highlight
Share
Copy

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee