Acts 2:2-4
Acts 2:2-4 PCM
At wons, one kind nois wey bi like heavy breeze kom from heaven kon full di whole house where dem sidan. Dem kon si small-small fire wey bi like kandol lite dey fall kom from heaven on-top dia head, one-by-one. Den di Holy Spirit enter dia body and as di Spirit give dem pawa, dem kon start to tok for difren language.