YouVersion Logo
Search Icon

2 Korintians 6

6
God Savants Wey Dey Sofa
1Naw, bikos wi bi fellow workers, wi dey beg una make una nor waste God grace wey una don receive. 2Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon! 3Wi nor dey do anytin wey go make anybody vex, so dat nobody go si any fault for awa work. 4But wi dey show sey wi bi God savant for evritin wey wi dey do. Wi dey sofa well-well and face trobol for dis time; even for wiked times; 5for di time wey dem dey beat us and put us for prison; for di time wey dem dey fight; for wahala time; for nite wey wi nor fit sleep and for hongry time. 6Wi dey do all dis tins with awa klean life, di tins wey wi know; di patient wey wi get; di good wey wi dey do for pipol; di Holy Spirit wey wi get; betta love wey wi show pipol; 7thru di word wey wi dey tish with God pawa; with wetin wi take dey defend awa raitiousness both for awa rite and left hand; 8for di time wey dem honor or disgrace us; for di time wen dem tok bad about us or praiz us; di time wey dem do us like sey wi dey tok lie, but wi dey tok trut. 9Dat time, e bi like sey nobody know us, but evribody know us; e bi like sey wi don die, but wi dey alive; wi still dey alive like pipol wey dem dey ponish, but dem nor fit kill us; 10wi dey like sey wi dey vex, but wi dey always happy; wi bi like poor pipol, but wi dey make many pipol rish; wi bi like who nor get anytin, but wi get evritin.
11So, una wey bi Korint pipol, wi don open awa heart tell una evritin. 12Wi nor dey whole awa love from una, but na una dey whole una love from us. 13So make wi make am ekwol. I dey tok to una like sey una bi my shidren, so make una open una heart for us too.
Una And Dem Nor Bi Di Same
14Make una nor make friend with pipol wey nor bilive, bikos, na wish kind friend raitiousness and bad tin won bi, or na wetin lite and darkness get togeda? 15And na wish kind agriment Christ and devil get? Wetin koncern pesin wey bilive and pesin wey nor bilive? 16Wish kind business God Temple and juju get? Bikos wi bi God Temple, just as God sey, “I go stay inside dem and waka among dem, den, I go bi dia God and dem go bi my pipol.” 17Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una 18kon bi una Papa and una go bi my shidren.” Na so God wey get all di pawa, tok.

Currently Selected:

2 Korintians 6: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in

YouVersion uses cookies to personalize your experience. By using our website, you accept our use of cookies as described in our Privacy Policy