Bikos God warn dem for dream make dem nor go back go meet Herod, dem kon pass anoda road go dia house.
Wen di wise men don go, God angel kon tell Josef for dream, “Get up, karry di pikin and en mama run go Egypt, make una stay der until I go tell yu wetin una go do, bikos Herod won kill di pikin.”