Jesus kon ask di man wey e dey follow tok sey, “Among dis three men, wish one yu tink sey bi neighbour to di man wey tif attack?”
Di man wey sabi di law well-well kon ansa, “Na di one wey kare for di man.”
So, Jesus kon tell am, “Make yu go do di same tin too.”