Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
“Pipol nor go nid to tish each oda about how to know God, bikos evribody go know mi; both doz wey poor and doz wey get money. I go forgive dia sins and I nor go remember di bad tins wey dem do before.
Mi, wey bi God, don tok.”