Den Israel bless Josef kon sey,
“Make di God wey yor grand-papa
Abraham and Isaak serve;
di God wey dey guide mi
since thru-out my life kon rish today;
di Angel wey don protet mi from all wahala,
bless dis boys.
My name and my papa Abraham and Isaak name
go shine for dia life.
Dia shidren go many
like san-san for dis eart.”