1
John 12:26
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Anybody wey ready to serve mi, go must follow mi and where I dey, na der my savant go dey too. Anybody wey serve mi, my Papa go honor am.
አወዳድር
{{ጥቅስ}} ያስሱ
2
John 12:25
Anybody wey love en life for dis world, go luz am, but di pesin wey nor love en life for dis world, go get life wey nor dey end.
3
John 12:24
I tell una true word, if one korn seed fall for groun and e nor die, e nor go grow, but if e die, e go grow kon bear plenty seed.
4
John 12:46
I kom as lite for dis world, so dat anybody wey go bilive mi nor go waka inside darkness.
5
John 12:47
“Anybody wey hear wetin I tok and nor obey am, nor bi mi go judge am, bikos I nor kom judge di world, but I kom save pipol for di world.
6
John 12:3
Mary take perfume wey dear well-well, wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg. Den e use en hair take klean dem. (Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).
7
John 12:13
Di pipol take palm tree leaf go wait am for road. Dem kon bigin shaut, “Hosanna, make God bless di pesin wey E send kom meet us. Make God bless Israel king!”
8
John 12:23
Jesus tell dem, “Di time don kom wen God go honor en own pikin.
ቤት
መጽሐፍ ቅዱስ
እቅዶች
ቪዲዮዎች