1
John 10:10
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Di tin wey tif dey do, na to tif, kill and distroy pipol, but mi, I kom so dat pipol go get life, di kind life wey full well-well.
አወዳድር
{{ጥቅስ}} ያስሱ
2
John 10:11
“Na mi bi di good shepad. Di good shepad ready to die for di sheep.
3
John 10:27
My sheep dey hear my vois and I know dem and dem dey follow mi.
4
John 10:28
I don give dem life wey nor dey end and dem nor go ever die. Nobody go fit take dem komot from my hand.
5
John 10:9
Na mi bi di door, anybody wey enter thru mi, God go save am. E go-go inside and out and e go si betta grass chop.
6
John 10:14
“Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.
7
John 10:29-30
My Papa wey give dem to mi big pass evribody and nobody go fit take dem komot from my Papa hand, bikos mi and my Papa, na one.”
8
John 10:15
Bikos my Papa know mi and I know am, naim make mi ready to die for di sheep.
9
John 10:18
Nobody go fit take my life from mi, but na mi go put am down by mysef and I get di pawa to take am back again. Dis na wetin God kommand mi to do.”
10
John 10:7
So Jesus kon tell dem again, “I dey tell una true word. Na mi bi di door wey di sheep go must pass enter.
11
John 10:12
Di pesin wey dem hire nor bi di shepad and bikos nor bi en get di sheep, e go run wen e si lion dey kom, so di lion go skata di sheep, kon kill di ones wey e katch.
12
John 10:1
“Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but klimb pass anoda side enter di place, na big tif.
ቤት
መጽሐፍ ቅዱስ
እቅዶች
ቪዲዮዎች